Village War

Village war - Kovu

Na cry we cry ,  I say na tears we drop
The land kasala , e don dey turn gbege
The chiefs don dey fight , unity get hiccup
Chief priest dey chop kolanut e say d gods are wise !

All the asawana Cutlass and all the long range gun
Our youths dey file Dem out begin dey ginger war
Papa dey appease en gods , mama dey cry for house
One on one take your post , if you run your father !

Village king no go yarn with en press press nose
Dem give and yam , give am oil with water to push am down
Govt give am small thing en dey smile go bank
Na generation war Dem start , had I known go end am

D gods wey wan settle quarell still dey ask for blood
7 matured virgins , chief priest for where you wan see am
Share the land make peace dey , Dem no go hear my own
Las Las wetin I know , I'm just a township boy.
#PidginPoetry
#PidginPoetry

Comments

Popular Posts